We Most Konfes Good
Paul rise ova shallenges of shipwreck and turbulence, and he enkouraged odas to dey follow hin footstep. Paul enkouraged odas to eat food afta 14 days of dea sailing krisis. He chop hin meal openly ad he talk am, “As day one break, Paul enkourage dem make dem chop kon say, ‘Today make am fourteen days wey una dey worry, sotey una nor gri chop. So naw, I dey beg una to chop, bikos una nid am to survive. And nobody among una go luz even one hair fo en head.’ Wen Paul talk finish, e take bread kon tank God fo dea front make all of dem see and e start to chop.” (Acts 27:33-35).
LESSON
Shidren of God dey expected to make positive konfesons all di time; however, we sometimes face tough situation wey go win make we act odawise. Bilivas must no fall fo temptason kon deny dea strong faith in God. We must not stop to dey make positive konfeson with expectason. Our heavenly fada no go witdraw Hin promise from us, but go make dem kom to pass.
PRAYER
Oga God, abeg teach me how to get faith and dey make positive konfeson wen things no go well. I know say you dey ever faithful, and you go keep your promise ova me. Abeg help me to keep trusting you ontil all my expectations dey met. Let your songs of viktory dey my mouth foreva. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
