God’s Laws And Principles No Dey Shange
Oga God take di way di Israelites no obey am as serious krime, and He promise say he go make dem sofa well-well if dem no repent. God talk am from Jeremiah, “Tell dem sey, ‘Di Oga wey bi Israel God sey, “Curse go follow doz wey nor gri obey di kovenant.” Wen I take Israel, my pipu komot from Egypt where di land bi like fire fo dea body, na dea I fo make kovenant with dem. I tell dem make dem obey and do evritin wey I kommand. I still sey, if dem obey mi, dem go bi my pipu and I go bi dea God. Den I go keep di promise wey I make with dea grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as You tok!” (Jeremiah 11:3-5).
LESSON
Oga God get hin rule wey he don do down wey we no fit bend. Di rules don dey down, but dey simple. Oga God konfam am say we must stay away from sin. We must love him kon love our neighbours join. If we honor Am, Jehovah go bless us. He go dey sure say Hin blessing show fo our life, so that oda pipu go dey shallenge to serve am.
PRAYER
Oga God, abeg give me grace to dey follow anitin wey you say well-well. I beg give me grace to dey love you and my neighbours. Make your blessing dey my life so that di unbilivas go won dey serve you. Abeg do am. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
