We Most Draw Near To Di Lord
A man or woman who fear God go enjoy Hin benefits; di pesin go receive God guidance and go dey live fo safety. Di psalmist tok say “How wi go take know doz wey dey fear God? Na doz wey God go show di rite road wey dem go follow. Dem go prosper and dea shidren go inherit di land. God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant. (Psalm 25:12-14).
LESSON
If we dey klose to God, he go dey klose to us well-well.Di Almighty God dey always find way wey he go take bless Hin shidren, but some pipu don tok say dem go dey far from God: therefore, dem no go enjoy Hin benefits. On di oda hand, small pipu wey dey kanpe wit God go enjoy hin benefits wey plenti. Howeva, he good make all pipu dey klose to God and dey serve am well-well, so dem go fit prospa and disgrace Satan.
PRAYER
God abeg, I don know way pipu wey dey klose to You dey enjoy plenti benefits from You, and i won join dem now! I don tok say I move kloser to u dan I don dey before. I go stop wasting my time and pawa on wetin wey no go benefit me, but I go put plenti effot to di relationship wey dey between You and me. I go dey praise you more dan ever, and I go dey serve you well-well. Abeg con give me di grace wey I go use keep all I use my mouth tok. Na fo oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
