The Genuine Life
Oga Jesus krist appreciated and recognized di pipu wey dey folow am wit high honor. He tok say, “My sheep dey hear my voice and I know dem and dem dey follow Mi. I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand.” (John 10:27-28).
LESSON
The life insurance wey get reword pass na to get life insurance in Oga Jesus krist. Oga Jesus Krist tell di pipu wey follow am say he go give dem life wey no dey finish. Since Oga Jesus Krist don show di pawa to live hin to die, com kolet am bak, he go do so for hin pipu wey dey follow am. Oga Jesus Krist folowas go die once,con wake up so dem go get life weh no dey finish.
However, pipu wey no belive am go die two times: Eartly and life wey no dey finish due for hell fire! Since Oga Jesus Krist don offa us say we go get permanent life insurance wey go lead to heaven, all pipu must to insure dea lives wit him.
PRAYER
Oga Jesus Krist, Hell Fire dey too hot and I no won go dere – and I no won make he be my home foreva! I won go to heaven wey peace dey! Now, I don tok say I go invest my future and destiny in you so I go fit enta heaven. Today, I don tok say I go sign up for your life insurance program wey dey neva fail: I konfes you Oga Jesus Krist as my personal Lord and savior, and I give you my komplete life foreva. From now on, I go dey serve you wit all my heart, and I go share my salvation experience wit oda pipu. God abeg come help me. Amen.
