Victory Is Sure For Children Of God
Haman plot to kill Mordecai fo di same time weh God don determine to promote am. God will prevailed over Mordecai; hin get promotion, but hin enemy Haman get disgrace and kill. (Haman die because of Mordecai and other Jews). Di bible report am, “That night di king no fit sleep. So e kommand one to bring records book of di chronicles; and dem read before fo di king front. And e found am written sey Mordecai don tell Bigthana and Teresh, two of the king eunuchs, di doorkeepers weh don lay hands on King Ahasuerus. Then di king say, “Which honor or dignity una don bestow on Mordecai fo this?” And di king servants weh attend to am say, “ Den no do anything fo am.” So di king say, “Who dey di court?” Now Haman just enter di outer court of the king palace to suggest say make king hang Mordecai fo di gallows hin don prepare fo am.” (Unfortunately, di game change fo Haman)…Haman naively suggest, “Then make di robe and horse be deliver to di hand of di king most noble princes, that him fit array di man weh di king delights to honor. Then parade am ontop horseback through di city square, and proclaim before am: ‘Na so ego be fo di man weh di king delights to honor!’” Then di king say to Haman, “Hurry, take di robe and di horse, as you don suggest, make you do like that fo Mordecai di Jew weh sits within di king gate! Leave nothing undone fo all wetin you don talk” (Esther 6:1-4; 6:9-10).
LESSON
God protection over Hin pikin dem no go fail under whatever circumstance. God pikin enemies go collect shame. Dem go kollect shame fo dea evil works and dey ridiculed. Meanwhile, God's children go sail unto victory fo all circumstances. Dem no go dey ashame during konfrontation. Since God pikin dwell under divine grace, dem go get renew energy to bring more praise to God name. Kristians get nothing to lose fo serving God; dem go forever live overcomer lives! Di bible assure, “If God dey fo us, who fit be against us?” (Romans 8:31).
PRAYER
Dear God i beg give me your enabling grace to remain your faithful pikin so that i fit kontinue to enjoy your divine grace and protections. Beat down my enemies until dem dey ashame, and make me exercise victory over dem! Make your goodness be abundant in my life, and make me forever enjoy your benefits fo di land of di living. I beg set your angels to keep dea watch over me so that i fit live forever under your pavilion! Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
