The Authority Of Jesus
Satan attempt to overthrow God in heaven, but he lost. Angel Michael and hin godly angels fight Satan and hin troop, and dem defeat di evil angels. Dem chase am out of heaven to face eternal kondemnation afterward. Meanwhile, Michael and hin fellow angels no go fit be able to defeat Satan if nobi fo God pawa comprised inside Oga Jesus Krist blood. Di bible talk am, “Dem overcome by di Lamb blood!” E dey reported, “And war break out inside heaven: Michael and hin angels fight with dragon; and dragon and hin angels fight, but dem no prevail, no any place found fo dem in heaven any longer. So dem cast out di great dragon, that serpent of old, call Devil and Satan, weh deceives di whole world; dem cast am to di earth, and hin angels dey cast out with am. Then i hear one loud voice in heaven say, “Now salvation, and strength, and di kingdom of our God, and di pawa of Hin Krist don come, fo di accuser of our brethren, weh accused dem before our God day and night, Dem don cast am down. And dem overcome am by di blood of the Lamb and by di word of dea testimony, and dem no love dea lives to di death” (Revelation 12:7-11).
LESSON
Pawa dey Jesus Krist blood to overcome Satan and hin kohorts. Satan trembles whenever di name of Jesus Krist is mentioned; hin also trembles in the same manner whenever the blood of Jesus Krist is mention. Angel Michael defeat di evil angel in heaven with di authority kontain in di blood of Jesus Krist (Revelation 12:7-11); kristians must use di same medium to defeat di enemy also. Both Satan and hin demons go tremble before Jesus' name and blood as dem do fo heaven. Dem no fit withstand Jesus Krist authority! Therefore, no Kristian suppose hesitate to use appropriate tools against hin or her enemies - di Name and Blood of Jesus. Believers suppose kommand Satan to get lost from dea lives to live overcomers' lives! Those weh do so no go regret dea action, but dem go live victoriously on earth. "Make somebody shout Hallelujah!"
PRAYER
In di name of Jesus Krist i rebuke Satan. I kommand di enemy to get lost from my life! I break hin pawa by di authority inside di name of Oga Jesus Krist! I also use di authority weh dey inside Jesus Krist blood to destroy all di enemy's influence fo my life. I triumph over Satan and hin evil forces from today, and forever! Di salvation of Jesus Krist be mine own, and Hin victory be mine own also. "Because i pass conquerors by Krist weh love me!" (Romans 8:37). Fo in Oga Jesus Krist name i exercise my authority. Amen.
