True Love
God pikin must demonstrate true love to other people; dey must also love unbelievers as di bible talk,
“Make you make brotherly love continue. No forget to dey entertain strangers, by doing dis kind tin some don unwittingly entertain angels. Remember di prisoners as if chained with dem—those weh dey mistreated—since unasef don dey inside di body (Hebrews 13:1-3).
LESSON:
A kristian weh claims to truly love God no suppose nurse hatred inside his/her heart. Every pikin of God dey required to dey do like Jesus Krist in speech and in deed! Believers must to seek di welfare of others. We must pray and take proactive steps towards di betterment of other people live! Meanwhile, our loving and charity activities nobi to dey limit to fellow believers alone. We must love the unbelievers, and be true person weh dey represent Jesus Krist fo in life, so that dem fit dey challenge to become kristians. Truly, e fit dey difficult to love di enemies, but Krist requires sey we love dem also! We dey challenge to pray fo those weh spitefully deal with us. Fo dis reason, we must seek God strength to do our due diligence. Believers must dey pray fo di empowerment of di Holy Spirit to meet God expectations fo all ramifications. With God strength fo our disposal, we fit do all things! We fit love our friends and enemies; we fit pray fo those weh dey despise us. Wen we seek God face fo strength, we fit stand uprightly and be true soldiers of Krist who no go fail di heavenly Master.
PRAYER:
Oga Jesus Krist, i beg teach me how to be good kristian. Give me pawa to run my kristian race as bible talk am. Make your Holy Spirit give me strength to love you with all my mind; give me pawa to love my fellow believers, and give me grace to love unbelievers too. Make your true love reign supremely inside my heart, so that your name fit dey glorify always. I beg make di light of your gospel dey shine fo this dark age, so that all people fit come to your true love and dey safe. I beg do these things and plenty more fo di sake of your name. Fo I make all my request in your precious name Oga Jesus Krist. Amen.
