The End Of All
God go soon draw finishing line fo dis world existence. He go bring all souls to Hin judgment throne. God go review every activity and reward everyone accordingly. He go cast Satan and hin followers to hell fire. Di Kreator go declare di Jesus Krist followers justified because dem don konfess dea faith in Am. Jesus Krist followers go be granted a permanent access to heaven wea dem go enjoy God everlasting peace and prosperity. Di bible state am, “Then i see one great white throne and Him weh sit ontop am, from pesin weh di face di earth and di heaven fly kommot . And dem no find place fo dem. And i see di dead, small and great, stand before God, and books dey open. And another book dey open, weh bi di Book of Life. And di dead bin judge according to dea works, by di things weh dem write inside di books. Di sea give up di dead weh dey imside am, and Death and Hades deliver dead weh dey inside dem. And dem bin judge, each one according to hin works. Den Death and Hades bin cast into lake of fire. This nah di second death. And anyone weh hin name no dey di Book of Life bin cast into di lake of fire” (Revelation 20:11-15).
LESSON
Di long-await Judgment Day of God go soon come on earth, and di faithful followers of Jesus Krist go be awarded with eternal life gift fo heaven. Satan and hin fallen angels go receive di reward of hell fire. Humans weh don refuse to accept Jesus Krist as dea Lord go also be hauled to hell fire. Dem go suffer fo hell fire forever. (Hell na place kontaining God unquenchable fire weh dey burn with high graded sulfur - Revelation 21:8). Meanwhile, di gracious God bin ever willing to forgive repentant sinner. He go save whoever repent from hin of her sins and konfess Jesus Krist as Lord. It is therefore important sey every soul immediately take di appropriate step of konfessing Jesus Krist as hin or her Lord before e dey too late. A person weh procrastinates fit miss opportunity of going to heaven since hin no know wen hin go die (or di time weh rapture will happen).
PRAYER
Dear God, I no won go hell fire, but i wan go heaven. I beg kount me worthy fo heaven! I understand seh faith in Jesus Krist nah di license to heaven; therefore, I konfess my faith in Jesus Krist. I believe sey Him bi di savior fo di world, and i accept Am as my personal Lord and Savior. I beg forgive my sins and grant me strength to faithfully serve you unto di end. I beg write my name fo book of life, and make me ever worthy fo your eternal kingdom. Fo in Oga Jesus Krist my Lord i pray and make declaration of faith. Amen!
