De Spiritually Sensitive
Di Pharisees bi bitter kritics of Jesus Krist; dem use dea religion as kamouflage to express dea jealousy and rage against am. Di Pharisees no hesitant to stalk Jesus all day long, and follow am on every turn to find an excuse to criticize and demean Hin ministry. Di bible report some of Pharisees' actions, “Now e happen fo di second Sabbath after the first weh Hin (Jesus) go through di grainfields. And Hin disciples pluck di heads of grain and eat dem, rubbing dem fo dea hand. And some of di Pharisee tell dem, “Why you dey do wetin no dey lawful to do fo Sabbath day?” Di bible also report am, “Now e happen fo another Sabbath, also, weh He enter synagogue and teach. And one man dey dea weh hin right hand wither. So di scribes and Pharisees dey watch Am closely, whether He go heal on di Sabbath, so that dem fit find accusation against Am” (Luke 6:6-7) (Luke 6:1-2).
LESSON
Satan love to station hin evil agents around godly pipu to frustrate dea efforts. Di enemy go focus to make attempt to derail believers from dea pursuits of righteousness by castigating dea work and throw every available stone with di hope one fit stick. Therefore to overcome di devil, believers must dey sensitive spiritually (watchful) and dey prayerful, and dem must dey filled with Holy Spirit also. However, believers must not forget Satan intention nobi to discourage dem from serving God only, but hin main motive mah to kill, to steal, and to destroy dea salvation (John 10:10). Hence, while we (believers) remain to dey prayl and watchful, we fit follow Jesus' examples and appropriately react fo all situations. Fo example, wen Satan instigate fury in Pharisees to waylay Jesus;
-
Jesus ignore di Pharisees – Believers suppose largely ignore dea critics.
-
Jesus remain persistent to dey do God business –Believers suppose never stop to dey do God will.
-
Jesus always withdraw to silent place to pray fo strength renewal after ministering –Believers must always refill and refresh dea energy through prayers.
-
Jesus change locations to avoid enemies’ distractions –Believers suppose diversify in ministry to outsmart dea enemies.
PRAYER
Dear God, i beg give me strength to overcome Satan and live triumphantly on earth fo di glorification of your holy name! Again, give me strength to remain focus and pay no damn attention to di devil and hin evil agents! Make your Holy Spirit empawa me to remain immovable, and to keep faithfully serving you during opposition and challenge. Also,make your Holy Spirit empawa me to dey watchful and prayerful so that i fit keep prospering fo all my ministerial activity, so that your gospel light fit spread throughout di world. Wen my earthly race don eventually over, make me appear fo your presence fo heaven to hear "Weldon and welcome my servant to di joy of your Lord!" Fo i make my request in Oga Jesus Krist. Amen.
