Prayer Dey Impotant
David pray a direct prayer wey dey useful to everyone wey won collect some benefits from Oga God. Di man David talk say, “Wen you dey fo trouble, make God answer your cry fo help. Make Jacob God name, safe you from all trouble. Make E kom help you from en temple, Den give you pawa from Jerusalem. Make E remember all di gifts wey you gi-am, den favor you, bikos of your offerings. Make E do everything wey you want and make you prosper fo everything wey you dey do.” (Psalm 20:1-4).
LESSON
Prayer dey essential to invoke di pawa of God to any situation. Believers are to express dea feelings to God through prayer; dey suppose to describe dea situation to God, and beg am to be involved. Howeva, di believer dey expected to use dea faith once dem don pray to Oga God. Prayers of faith go allow Oga God to put mouth fo any situation and fight ontil we win. On di oda hand, di faith wey we apply go force believer to dey glorify God once dey don see di viktory wey dem dey find.
PRAYER
In the name of Oga Jesus Krist I command di challenges of my life say make dem bow! I kurse Satan and I command am make e komot hin dirty hands from my life. I command sickness, poverty, failure, sin and all di work of Satan to stop in my life. I get my victory today, tomorrow, and forever in di name of Oga Jesus Krist. Amen.
