Stand Clear Of Ungodly Practice
Gospel ministers dey directed to teach and lead pipu to become good stewards of Jesus Krist. The bible talk am,
“But as fo you, speak di things weh go proper fo sound doctrine: weh go make di older men sober, reverent, temperate, sound in faith, in love, in patience; di older women same thing, so that dem dey reverent in behavior, nobi slanderers, nobi given to much wine, teachers of good things—that dem go admonish di young women to love dea husbands, to love dea pikin, to dey discreet, chaste, homemaker, good,dey obedient to dea own husbands, sey di word of God no go be blasphemed. Likewise, exhort di young men make dem get sober-mind, in all things showing yourself to be pattern of good work; in doctrine make dem show integrity, reverence, incorruptibility, sound speech weh no fit dey kondem, that one weh bi opponent fit dey ashame, have nothing evil to say about you” (Titus 2:1-8).
LESSON:
Kristians suppose live according to bible standard - and nothing more or less! Believers dey required to stand clear from ungodly cultural practice as dem surface and re-surface. As e dey today, world culture and practice no go cease from changing, but believers must not be caught up fo dis same syndrome. Pipu will demoralize God laws to suit dea selfish desire; believers no suppose be part of that! Thank God we get bible, and di standard no change! Fo dis reason, we believers must adopt our culture from am! Since we be heavenly bound pipu, we must observe God law to di letter, and we must ensure sey we reference our practice from am. Heavenly God na serious kind, and Hin no go change Hin mind as men do. Men fit change, but God requirement fo heaven no go change! Fo dis reason, anyone weh desires to go heaven fo di last day must stand to hin or her feet to comply to God law.
PRAYER:
Dear God, I no sey i never reach dear yet! I still dey unfit fo your kingdom! I don compromised your requirements fo heaven. I don follow multitude to sin against you! However, I don decide to turn a new leaf: I don repent from my errors; I beg you to forgive my failures and clean me. I beg make me fit fo your kingdom. I believe inside your Son Jesus Krist, and I accept Am as my Lord and Savior. From now on, I beg give me strength to stand up fo righteousness and do your will with all my heart- even wen e no go make me popular. I beg equip me with your Holy Spirit to stay fit fo di second koming of your Son Oga Jesus Krist. Count me worthy fo heaven! Fo in Oga Jesus Krist nam i make my requests. Amen.
