Satan No Fit Overcome Di Believers
Some members of Oga Jesus’ family lost di salvation and miraku chance wey he give dem. Bekos say dem don dey togeda, Oga Jesus family find am hard to accept him as dea savior. In fact, hin half brodas no accept di gospel wey he dey preach and dem dey mock am. Oga Jesus brodas believe say he no get kourage, and dem use style ask am make he go into di public areas – with di hope say some Jews wey get sense go disgrace am. Oga Jesus brodas talk say, “Komot fo here go Judea, make your disciples si di mirakles wey you dey do. Bikos anybody wey won make pipu sabi who e bi, nor go do anytin fo korna. Since you dey do dis tins, e good sey make you show yoursef to everybody.” (John 7:3-4). But di pharisees wey know Oga Jesus family mock am say,“ We sef know di place where dis man from come and we know sey anytime wey Krist go kom, nobody go fit know where e go kom from.” (John 7:27). Howeva, Oga Jesus give answer to dose wey dey mock am say, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take come, na God wey send mi na Him bi di korrect Pesin. But una nor know am. But I know am well-well, bikos na from am, I come and na Him send me.” (John 7:28-29).
LESSON
Devil dey always dey jealous of Oga Jesus’ success, and e go try anything to show say he dey vex. e go won attack di followers of Oga Jesus. Satan go try anything wey kom hin mind kon use am against di kristen, with di hope say e go make dem fall. Di enemy fit make our family and friends turn our enemy; trails fit come from far place also. Howeva, di skripture don talk am say Satan no fit ovacome di children of God. He go try, but he no go win over Oga Jesus, he no go win over Oga Jesus followers too! God grace dey enough fo believers to overcome Satan so dem go dey enjoy on eart. Hallelujah!
PRAYER
I komand Satan make he stop to dey disgrace me! Devil na liar and he be looser. He no fit win hin battle against my spul. My spirit, soul, body dey kanpe fo di blood of Oga Jesus Krist. Since Oga Jesus don die kon wake up from di dead, I don dey pawaful! Anyhow wey Satan won use to frustrate my effot na just waste of time fo am. I no be ordinary pesin since I don turn di child of Oga God. Di sekret wey dey behind say I dey successful kon get strength dey fo di centre of Oga Jesus heart; so, I be wina today, tomorrow and forever! Amen.
