Oga God No Dey Do Partial
King David check hin past kon see say God don make him successful witout say he get any beta background or experience. Di King understand say dem no born am with silver spoon; neither he get any success habit. Yet, Oga God choose him fo greatness since he don risk hin life to kill Goliath and defend him kontry (and also to promote di name of God). Di kreator wey turn Shepherd David to a King, and he don make him dey successful. Also, David, decide say he go humble hinsef once he know say he be “nobody” until Oga God turn am to become “somebody.” Di King humble hinsef kon say, “Oga awa God, your greatness full di whole world! Your glory high pass di heavens. You don teach children and small pikin, so dat dem go fit talk about your pawa and how You take silent your enemies and doz wey dey oppose You.” (Psalm 8:1-2).
LESSON
Oga God no dey do mago-mago, he dey use and bless any pesin wey do wetin he want. He no dey prefer di rich to di poor, and he no dey pity di poor at di expense of di rich. Oga God go use anyone wey make hinsef available fo him – whether rich or poor. On di oda hand, pesin wey God use dey fortunate! Di fellow go receive great blessing. Pesin wey bekome di instrument of God fo any special mission go get plenti riches and honor to pass down to hin generason. (Kongratuleson to pipu wey don make demsef available fo God use, since dem go dey blessed fo sure!)
PRAYER
Oga God, abeg kon use me! I understand say you go bless me if I dey available fo your use; so, I don talk say I go release mysef fo your use. From now, I go do whatever you say make I do with joy, and I go do am well-well. Abeg showcase your grace and pawa through my obedience, and let me prosper fo everything wey i dey do. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
