Praise Ye The Lord
Evri living soul most to praise God for his loving kindness to humanity. A psalmist talk di goodness of God say, “ Make wi tank God, Bikos E dey good and en love dey-dey forever.” (Psalm 118:1).
Lesson:
Oga God be di kreator of all living, and he deserves di praises of hin pipol evritime. We no fit talk how hin kindness be to us! So, evri nashon, tongue, and tribe should sing praises to him. All pipol should most to show dia gratitude to di King of kings and Lord of lords. Everione should sing songs of praises and appreciate him for all hin kindness. In fact, di kreator deserve special offerin and thanksgiving; evri living pesin most offa him quality praise. Let di living soul shout Hallelujah!
Prayer:
Oga God, how great and wondaful you be to me! You don turn my mourning to dancing, and you have dignified my life. You be my living hope, and my praises shall be directed to your holy name evritime. I go praise and magnify your name among di living souls. I go sing, jump and shout Hallelujah to your holy name foreva! Abeg give me heart wey dey grateful evritime, and let your praises neva leave my mouth. Kon give me pawa to praise you today, tomorrow, and foreva. Let heaven know me as a signal of praise to your holy name now and forevamore! Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
