Maintain Holiness To Di Lord For Your Body
God no like fornication and adultery, and he command him pikin to abstain from the practices. The Bible talk say,
“na wetin God want be that, your holiness: that make we commot ourself from sexual immorality; that each of una should sabi how to possess his own vessel in sanctification and honor, no to dey get passion for lust, like the Gentiles who no sabi God; that make una no take advantage of and defraud him brother in this matter, because say the Lord is the avenger of all such, as we also forewarned you and testified. For God no call us to uncleanness, but in holiness” (1 Thessalonians 4:3-7)
LESSON:
Fornication and adultery na sinful tin, and them they irritate God. The Creator no fit dey happy with pipol who them dey do am. The Bible take say "Our body na temple of God" (1 Corinthians 6:19). Therefore, make every child of God most live a sanctified life so that he or she go fit receive his due benefits.
PRAYER:
Dear God, I dey sorry fo all di immoral sin wer I don commit. I understand say my body na di temple of di Holy Spirit, I dey determine to shun fornication and idolatry. From today so, I go maintain purity as a true pikin of God, and I go dey maintain consistent relationship with you always. Abeg give me strength and grace to remain steadfast with you unto the end. For in the name of Jesus krist I make my requests. Amen.
