Praise God
Musical instruments dey useful to dey praise God, and make we use dem to Hin satisfactions. A psalmist challenge pipu to explore praising di kreator with use of kreative art. He say,
“Make una give di Lord praise! Make una praise God in His sanctuary; Praise Am in Hin mighty firmament! Praise Am fo Hin mighty acts; Praise Am according to Hin excellent greatness! Praise Am with di trumpet sound; Praise Am with di lute and harp! Praise Am with di timbrel and dance; Praise Am with string instruments and flutes! Praise Am with loud cymbals; Praise Am with clashing cymbals! Make everything weh get breath give di Lord praise. Praise di Lord!” (Psalm 150:1-6).
LESSON:
God nodey eat physical food, but He eats praise! He takes pleasure inside worship activities weh Hin pikin offer Am. However, He honors praise dey quality and worships pass anything. Jehovah also appreciates worship activities weh dey presented with kreative arts. It is therefore important sey everyone dey thoughtful of di kind praise and worship weh him (or her) offer to God. Our deep and genuine praise go lead to blessings. If we kontinue to dey appreciative, di heavenly papa go respond with multiple blessings, so that we fit get more reasons to praise hin name.
PRAYER:
Dear God, I beg teach me how to praise you genuinely. In fact, I go start to praise you from this moment! I gol praise you fo all your benefits in my life: You don bring me from miry clay and set my feet upon dig rock. You don give me new songs, and don decorate my life with multiple blessings. I go loudly shout di praise of your name; I go praise you from coast to coast, and I go testify to your goodness always. I beg help me remain grateful to you fo all your kindness, and make me ever be beacon of praise to your name. For in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
