God Hates Sexual Immorality
God pikin dem must make dedicated efforts to abstain from sexual sin, since di practice irritates God. The bible warn believers to konsider am as a serious offense to engage in sexual sin. E dey written,
“I write to you in my letter make you no associate with sexually immoral pipu ...But now I don write to you make you no keep kompany with anyone weh dem name brother, who dey sexually immoral, or covetous, or weh bi idolater, or reviler, or drunkard, or extortioner— make you no even eat with such person” (1 Corinthians. 5:9-11).
LESSON:
E dey prestigious fo kristian to stand uprightly with God in holiness; e also dey shameful fo any kristian to engage inside sexual sin. God hates sexual immorality, and He no want Hin pikin dem to engage inside am. He go withhold Hin benefits from pipu weh kontinue in di sin. However, anyone weh genuinely repents from sexual sin and change fo good go receive God blessing. Therefore,make everyone examine hin or her way; make necessary amendment, and walk uprightly with God fo holiness.
PRAYER:
Dear God, i beg safe me from sexual sins. Kreate klean heart inside me and
renew right spirit within me! I dey sorry fo all my sins weh i don sin before. I dey sorry fo all sexual sin weh I don commit. I beg help me male i get fresh start with you. Make me serve you with the beauty of your holiness, and make me walk uprightly with you all di time. Make your Holy Spirit keep me fit fo your second koming. I beg write my name fo di book of life, and make me qualify to partake in your heavenly banquette. For in Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
