Persecuted For Di Gospel And Togeda
Anti-gospel pipu kill Stephen bekosof di faith wey he get in Oga Jesus Krist. Dem throw am stone till he die. Howeva, Before he die, Stephen don receive a trance and he see Oga Jesus Krist dey komend his undefeatable faith. Di man share hin experience wit the pipu wey wan kill am, he say, “Look! I si heaven wey open and I si Jesus Krist, God Pikin, stand fo En right hand.” (Acts 7:56).
LESSON
Any bodi wey sofa fo di sake of di gospel go reap big reword from God. God savants fit taste some rewords on eart, but no eartly reword fit dey kompare to heavenly rewords. Anybodi wey sofa fo di sake of Krist and Hin gospel go be King fo heaven. Di choice savants of God go dey specially decorated for heaven, and di glori of dia honor go show fo all di provinces wey dey heaven.
PRAYER
Oga Jesus Krist, abeg anoint me wit grace to dey preach indispensable gospel. Increase my faith to stand firm wit di task of evangelism. Help me make I dey preach your gospel evritym witout fear. Abeg help me to be your true ambassador, lete bring plenti rewads to your kindom. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
