Giving Our Possessions To God
King Solomon built a state-of-di-art temple fo God. He use materials wey dey kost fo di project. Di King make sure say dem use konfam gold decorate evri important part of di temple. Di bible tok say, “Dem kover di temple fo inside with gold kon use gold shain cross and kover where dem dey pass enter. Dem kover evriwhere fo inside di temple with gold, plus di altar wey dey di “Most Holy Place.” (1 Kings 6:21-22).
LESSON
God deserves beta gifts from Hin shidren. He dey always dey faithful to his shidren, and he nid make we dey appreciate am well. Di kreator offas Hin shidren evritym protection and provisions; Di last tin wey anybodi go do na to appreciate God wit di best materials wey he/she get. On di oda hand, notin dey too big to give to God. Any tin wey we offa to God no still okay di amount his goodness ova us.
PRAYER
God abeg, help me make I love you more dan silver and gold. Help me to dey freely give you my best offerings. Make me make I give you witout any komplain. Help me make I dey appreciate you with beta offerins wey go bring your uncommon to my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
