Nid to work faithfully wit God
Israelites dey do mago-mago wit God afta Joshua die, afta say plenti judges don try call dem to oda. Dey kon dey komit sin well-well till oga God tire fo dea mata, he kon punish dem, he no kon dey protect dem again, kon allow dem sofa. So, di enemis sofa dem well-well ontil dey kon repent. Dey kon know wetin dem do wey no good, kon cry to God fo help, Israelites kon talk say;
“Wi don sin against You. Wi leave You kon dey woship Baal juju.” So God ansa dem, “Wen Egypt, Amor, Ammon, Filistia,Sidon, Amalek and Maon pipu, opress una before and wen una kry give mi, I nor kom safe una from dea hand? but una still leave mi kon dey woship oda gods, so I nor go safe una again. Make una go kry give di gods wey una don choose, so dat dem go kom safe una wen una dey trobol.” But Israel pipu tel God, “Wi don sin. So do us anytin wey you like, but today, we dey beg sey make you kom safe us.” (Judges 10:10-15). Howeva, God kon later show kindness to hin pikin, he forgive dem dea sins and he return dem to him.
LESSON
We kristen be apple fo God's eye and we dey enjoy hin benefit well-well. our fada wey dey heaven no go like am if we go komit sin. He fit no dey give us di benefits wey he dey give us ontil we repent from our sins. So, all belivas must to work faithfully wit God so we go fit enjoy hin grace and goodness wey plenti.
PRAYER
God abeg, i don talk am to dey serve you faithfully, i repent from my sins and i don turn my back to any sinful habit. From now, i go make you happy by say i go dey do wetin you want. Abeg, give me grace so i go fit kip my promises, kon make mi receive your benefits. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
