Kol To Repetans
Oga Jesus krist kompare God to a rish man who don get wetin he want without distractions. He tel di stori of di rish man, he say;
But Jesus tel am, “One man do big party kon invite many pipu kom. Wen di party time rish, e kon tel en savant make dem go tel evribody wey e invite sey, ‘Make una kom, bikos evritin don ready.’But all of dem kon dey komplain one-by-one. Di first one sey, ‘I just buy land and i won go si am. Abeg, make you nor vex.
Anoda one sey, ‘I just buy ten melu and I dey go look how dem bi. Abeg, make you nor vex.’Di last one kon sey, ‘I nor go fit kom, bikos i just marry new wife. So di savant kom back kon tell en oga evritin wey dem talk. Di oga vex well-well kon tell di savant, ‘Make you go all di street and korna-korna wey dey dis town, go bring poor pipu: pipu wey dea leg or hand kut komot and pipu wey nor fit waka kon di party. Afta, di savant sey, ‘Oga God, I don do wetin you talk and di party neva still full. so di oga tel di savant, ‘Make you go main road and enter evriwhere fo di area, tel pipu make dem kom, so dat my house go full.’ Bikos I tel you, nobody among dos pipu wey i first invite, go taste my food!” (Luke 14:16-24).
LESSON
No how we go take beg God make hin allow sinas enta heaven. God don send his invitations to all pipu through hin son oga Jesus krist. Eni one wey receive oga Jesus as hin personal Lord go dey accepted fo heaven, eni one wey reject am no go fit enta heaven. So, all pipu must know say oga God dey strong and he go do anitin wey he don talk fo hin heart.
Evrione sopos dey fear God and dey obey hin kommandment. we must to listen to God offer on salvation wey he sent through oga Jesus krist so we go fit enta heaven.
PRAYER
God abeg, i don ready to yield to your invitation of salvation. Today, i (mention your name) give my life to oga Jesus krist. I accept am as my personal Lord and savior. I konfes my sin and leave am. From now on, i go serve you and i go glorify you wit evritin wey i get. abeg make mi qualify to enta your kindom. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
