Holy Spirit go help us win over sin and weakness
God don give his kommandment to di Israelites wit promise of blessing weh get kondition. He talk say di pipu go dey do well if dem obey him law, but dem go sofa if dem no obey him. Out of di 14 verse wey dey Deuteronomy Chapter 28,God kon use 14 verse to talk about him blessing wey get kondition, he kon use di remaining 54 verse curse if dem disobey him law.
He get some promise wey dey fo di Israelites 'obedience as he dey down, "If una really obey God kon keep en kommand wey i dey give una today, di Oga una God go make una high pass all di pipu fo di world una go get all dis blessings if una obey di Oga una God, God go bless una towns and una fields,God go bless una children and una plants,e go still bless una animals and dea pikin wey dem go born,e go bless una basket and una plate, anywhere wey una go and anythings wey una dey do, God go bless am, God go make una win una enemies wen dem attack una, dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side". (Deut 28:1-7).
He get some curses wey dey for the Israelites 'disobedience as he dey down "But if una forget di Oga una God and una nor gri obey en kommand and laws wey I dey give una today, den all dis curse go kom meet una with full force,God go curse una towns and fields,e go curse una basket and una plate. God go curse una shidren and una plants. E go still curse una animals and dia pikin wey dem go born,Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go curse am. Na God by ensef go send curse, problem, wahala, konfushon and e go dey fight una for evritin wey una dey do, until una skata and die finish, bikos of di wiked tins wey una dey do and bikos una don turn from am". (Deut 28:15-20).
LESSON
The law wey God make na for human blessing to say pipol who obey him law no go sofa for beta tins, as God go dey do wetin dey need for dem. So, we must to dey follow God's rule evri time. No be say make we follow him rule di time wey we like but we nid to dey follow am evri time. Jehovah wey make law for inside the bible no go dey look if pesin no gree follow am. He go bless dose wey follow am and go sofa dose wey no gree follow am. God don dey ready to follow pesin wey fall for wetin God dey expect.Him go forgive ant pesin wey fall for wetin him talk before wey con come back con beg. God go help pesin wey no fit meet wetin him talk by say him go give am di Holy spirit , wen holy spirit don dey, evri pesin go commot for sin domot go con dey live as God talk am.
PRAYER
Oga God, i know say u get how u dey bless dose wey follow ur kommandment. me i wan follow am. Abeg help me to dey follow an well-well. Put am for my heart so i go deu walk jejely for ur side. Abeg make your Holy spirit dey for me so i go fit follow wetin you dan tok down so i go dey doe well-well for evru days wey i go use for my life Na for Oga Jesus name i beg all dis AMEN
