Christians nid to dey do like oga Jesus for ministry so dem go dey kampe
Oga Jesus Christ bring back to life pesin wey don die, he kon give am to him mama who think say her only hope don finish. The bible talk am fo wetin happen wen oga Jesus don neat di gate of di City, dem bring kom a dead man weh con bi di only son of him mama, Di woman sef no kom get husband, wen Oga Jesus see di woman, he sorry fo am, he kon tell her"make she no cry". He kon come use him hand touch di koffin wey dey open, dose wey carry di dead body come kon stand dey look He kon say"yong man, i talk am to you, stand up". The dead bodi kon stand up, he kon dey speak and he give am to him mama (Luke 7:12-15)
LESSON
Oga Jesus Krist get a big work wey be to talk am fo di gud tin weh bi di kingdom of God.
while he still dey here on eart. He walk on top land and sea so he go fit get am fo wetin he kon do. No bi to preach am fo di Kingdom of God na him di son of God dey fo but him dey get pity for pipu wey dey around him. Oga Jesus dey always dey outside so him go fit meet wetin pipu need fo physical and spiritual. For example, him use five bread and two fish feed pipu wey pass five thousand wen he know say hungry dey catch dem. (Luke 9:16). Him still bring back to life pesin wey die wen him see how him mama dey cry. (Luke 7:12-15).
We (Christians) must sabi di way wey Oga Jesus dey do, we must dey feel pity fo pipu wey dey around us. we must to dey try to give fud to d poor, give cloth to pesin weh no get and visit pesin wey no well because na dis we fit make everybodi know di gospel wey we dey share. We must dey pray for pipu wey dey sofa. If we don dey pity dem, di light of di gospel go shine well-well and plenty pipu go won come so dem go know Oga Jesus and dem go dey safe.
PRAYER
Oga Jesus krist, i beg help me so i go dey get pity fo oda pipu. I nid powa and joli heart so as i dey show love fo pipu, dem go dey com your side. Make your grace and good tins dey follow me so i go make di light of the gospel shine well-well. Abeg con give me strength so i go dey do like you on dis earth so dem go fit accept me for your kingdom also. Na for Oga Jesus name i beg for all dis. AMEN
