God Protection Dey Sure
Enemis bin surround David and dem wan attack am, but he no dey open to attack. He tok say make God defend am, so he cry to God say, “But my Oga God, I trust You, bikos na You bi my God! My future dey your hand. Make You safe mi from my enemies pawa, bikos dem won kill mi. Make your favor shine on your savant. Make You safe mi with your love wey nor dey fail. My God, nor let dem disgrace mi, bikos I dey koll make You kom help mi. Instead, make disgrace follow wiked pipu and make dem die go dea grave, where dem go dey silent forever.” (Psalm 31:14-17).
LESSON
We wey be Kristen do right to ask God fo Hin blessin and protections. Since we be Shidren of God, we dey free to ask Him anitin wey we want. On di oda hand, make anitin wey we go dey ask no be only fo Hin provisions, make we ask fo Hin protection join. Belivas must to show dea faith anitym wey dem pray. God wey love hin pikin well-well no go stop to dey bless dem and bring dea enemis onda Hin feet.
PRAYER
God abeg, I don know say na me be di person wey hin joy plenti pass bekos say I get u as my God; therefore, I konfam my trust in you. I kommand all shallenging situasens wey surround my life make dem bow in the name of Oga Jesus Krist! Again, I tok all bad situasens wey dey harass me to fall in di name of Oga Jesus Krist. Since I be shaid of God, I get pawaful authority to kommand situasens make dem listen to me; I rebuke Satan and I kommand evritin wey he dey use punish me make dem become wasted in di name of Oga Jesus Krist. Amen.
