Di Love Of Christ
Oga Jesus Krist kry bekos say he see a famili wey dey inside pain ova Lazarus wey die. Dey write am fo di bible say, “Jesus kon kry” (John 11:35).
LESSON
Oga Jesus Krist love and care fo Hin folowas well-well, and He no go leave den wen dem dey inside wahala. We Kristen dey fortunate bekos Oga Jesus Krist go follow us through all our life journeys, and he go share from our pains Di savior go wok around situasens wey no good kon turn am to our blessin. Di son of God no go rest ontil he don give us victory ova all situasens of life. Make a beliva shout “Hallelujah!”
PRAYER
Oga Jesus Krist, wat a wondaful savior you are? You neva sleep or slumber, but you dey watch ova me evritym. I love you so mush! Since you be my konfidant and sekurity, I go folow you all di days of my life. I give my life patapata to you from now and foreva more! I go also tell di whole world say you be di savior of di world, and make all di pipu folow you. Amen.
