Evangelism No Based On konveniens
Di church wey dey fo Jerusalem do a meeting wey be say whether make free non-Jewish Kristen to dey do dea Jewish tradison. Di meeting kon konklude say he dey impotant make kristen dey serve God as dey want fo dea spirit so dat di gospel no dey stop to dey spread. Di church elders write leta as he dey down here say, “…But fo Gentile pipu wey don bilive, wi don write leta go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sakrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor tosh groun and make dem nor sleep with who dem nor marry.” (Acts 21:25).
LESSON
Non-Jewish Kristen and Jewish Kristen be di same pipu fo di face of Oga God. Mago-mago no dey wit Oga God! Howeva, a kristen wey be from any background must to obey di law of Oga God. We must to dey involved in aktivities wey dey praiseworthy. No kristen must to change di law of God fo Hin own tradition. A tradison fit ginger us to dey do good, but no go make us dey kanpe to God standard of holiness. To tok am small, human tradison no be di law of oga God! So, evri kristen must to dey stodi dea bible to ondastand wetin Oga God want. We must to dey stand by di word of God. (We must to dey pratice am). Oga God go bless us well-well if we obey Hin law kon dey serve am faithfully.
PRAYER
Oga God, I don learn say human tradison dey different from your standard of holiness. Now, I dey ask say make you please save me from any traditson wey go make me konpromise your holines standard. Kon make me to komit mysef to dey stodi your word so o go fit dey live di kain life wey dey acceptable before you. Abeg help me to dey fit fo your life wey no dey finish kindom. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
