Dey Seek The Face Of God
David and him followers lost dea family and possessions to foreign invaders, and dem lament bitterly. No one know di next thing to do, except David! Him consult God fo directions, and God help am. Di scripture report am, “So David and him men come fo di city, and fo dea, burn with fire; and their wives, dea sons, and dea daughters been dey captive. Den David and di people who dey with am lift up dea voices and cry, until dem no get power to cry again. And David two wives, Ahinoam di Jezreelitess, and Abigail di widow of Nabal di Carmelite, been dey captive. Now David come dey greatly distressed, fo di people talk say dem wan stone am, because di soul of all di people dey grieved, every man fo him sons and him daughters. But David strengthen himself fo di Lord him God. Then David talk to Abiathar di priest, Ahimelech pikin,abeg bring di ephod here fo me. And Abiathar bring di ephod to David. So David inquiare from di Lord, dey talk say Sey i fit pursue this troop? Sey i fit overtake dem? And as e answer am, Pursue, fo you go surely overtake dem and without fail recover all. (1 Samuel 30:3-8).
LESSON
God still dey talk, and him go direct him people wey prioritize to seek him directions ontop any matter. shame no go ever catch People wey call on God, and dea footsteps go dey far from failure. All people dey encouraged to seek God and daily ask am fo directions so that dem go prosper the scripture don emphasize say God order di steps of righteous ones! (Psalm 37:23).
PRAYER
Baba God, abeg enable me with grace to seek your face over all matters so that I fit prosper. Allow me follow your instructions when you lead. No let me allow situations of life make e overwhelm me to di extent say i no forget to cry unto you fo help. Make i consult you over all matters, and make i prosper fo your name. Na Jesus krist name i take make my requests. Amen.