Dey Humble
All people been nothing but breakable clay for Di hand of Deir potter. God na Di potter and we Be Di clay. E get autonomous power over us; Na him b Di maker of Di universe, and all things submit to am. God talk for bible,
“O house of Israel, can I no do with you as Dis potter?” say Di Lord. “Look, as Di clay be for Di potter’s hand, so nazo una be for my hand, O house of Israel!” (Jeremiah 18:6).
LESSON:
We human being no dey all-in-all, but God dey. We dey subject to him, and E get final authority over us. We no dey allow to do anything wer we like, unless dey satisfy Di Creator. We dey require to revere him with honor and obey him commandments, so we go fit prosper.
PRAYER
Dear God, abeg keep me humble before you, and let me reverence you with dignity and honor. No let me be full of myself and disrespect you for anyway. Since you be Di potter and I be Di clay, let me yield to your instructions so I go fit prosper in all my ways. For in the name of Jesus krist na him I make my request. Amen.