We Most No Dey Waste Time
Mr. Tertullus, one lawyer wey Paul opponents hire strike out against Paul and christenity. He talk say, “Bikos wi don si dis man sey e find troubles and kause wahala among all di Jew pipu fo di world and naim dey lead di gang wey dem dey call, ‘Di Nazarenes’. E even take Greek pipu enter di temple, so wi kon arrest am” (Acts 24:5-7). Paul kon shun Tertullus, but defend hin faith in di kourt with sense. Paul talk hin speech and talk to di judge, “…But I go let you know sey I dey worship di God wey awa grand-grand papa dem dey worship, as dea tradition talk (wey dis pipu sey na one kind gang). Dem believe everything wey di law talkk and wey di prophets write down. I get hope fo God (di kind one wey dis men get too) sey one day, pipu wey don die, weda na bad or good pipu, go wake-up. Na bikos of dis I dey always try my best to get clean belle fo God and pipu front.” (Acts 24:14-16).
LESSON
Christenity dey always face opposition from unbelievers(and go continue to face am). God dey well and dey able to defend us if we dey challenged. In as much as God dey on di throne, no force fit ovapawa us. We christian be children of light, wey no darkness fit ovacome We no be ordinary pipu; We be God servants, and we don dey anointed by Oga Jesus Krist to dey preach hin good news to all ova di eart. On di oda hand, believers no fit afford to sit with opponent wey no dey reason well kon dey waste precious time wey dem need to further di preaching of di gospel. Christians must to dey avoid wasting time with pipu wey dey sturbon in dea old fashioned way of thinking and no go consider di benefits of gospel. Believers must to concentrate dea efforts on sharing gospel with pipu, kon pay attention to dea willing audience. Also, we must to follow up with pipu and dey sure say dey remain consistent in dea faith with di Lord. Our christian effort must to dey productive in all areas of our life. As e dey compulsory, we must to dey prayerful to receive di grace of God and strength to dey stand in faith every time.
PRAYER
In the name of Oga Jesus Krist I receive pawa and grace to dey continue to preach di gospel wey no body fit reject. I receive Krist anointing to dey share hin gospel to every land, nation, and tongue. I receive pawa of Holy Spirit to stand gidigba in faith and dey kanpe in my confection of Oga Jesus Krist. In di name of Oga Jesus Krist I confirm my authority ova di devil and all hin pipu and instrument: I command dem to bow in di name of Oga Jesus Krist! I win every pawa of di enemy wey dey out to silence me. I command Satan say make e komot from every aspect of my life, so I go dey continue to shine di gospel light to all di eart. Na fo Oga Jesus Krist name I use my authority! Amen.
