We go get some kain power as a believer if we dey study di word wey oga God don put down
Na oga God talk say make Joshua dey lead di Israelites, he kon tell am say make hin no fear di work wey dey hin front. He kon tell tell am say hin go help am get all di land wey hin don promise him pipu. Oga God tell Joshua Anywhere your leg touch, I don give am to you, just as i promise Moses. Una land go start from di wilderness wey dey south fo Lebanon go reach di north, e go rish di great Eufrates river fo east (plus evrywhere fo Siria) and from dea go Mediterranean Sea fo west. Nobody go fit stop you still you die. I go dey wit you as i dey wit Moses. I nor go forget or leave you.(Joshua 1:3-5).
Oga God kon give am di secret to success join di promise wey hin give am. He talk am fo Joshua say he go dey successful if hin no leave wetin don dey down fo di bible. God talk am say "Make sure sey you dey strong well-well and you get heart! Make you dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give you! Nor do dem anyhow, den you go prosper fo everything wey you dey do. Dis law wey God give you must nor komot from your mouth! You must dey read and think of am everyday and night, so dat you go fit obey everything wey dey inside. Den your way go dey right and everything go betta fo you. I dey talk again, so dat you go dey strong kon get heart! Make you nor fear or shake, because mi wey bi di Oga your God, I dey with you fo everything wey you dey do.”(Joshua 1:7-9).
LESSON
Chidren of God must to dey read di word wey God don write down so dem go dey joli, di word of oga God wey bi di bible dey talk pipu mind so dem go know wetin oga God want and do am well-well. Believers go dey work on wat oga God don plan fo dea life if dem understand wetin God don put down fo hin book. Pesin wey dey read am fo God word go get anointing weh him go fit walk on di way wey God don put down fo am and dem go see oga God's blessing. If we dey study di word of God, we go get di power ova di enemie, to say he go dey kampe to stop am fo anything wey di enemies won do and hin go dey kampe to stop am. He get something wey we must say, di bible sef don talk am, satan no fit wait if we dey pray kon dey back am up wit wetin dey down fo di bible. Di enemi go dey fall wen he hear say Kristen dey talk di word wey dey down fo di bible fo hin prayer and he go run since plenty joli dey fo dose wey dey read am fo di bible, believers must dey read well well.
PRAYER
God abeg, kon make me kristen wu go dey read your word time to time so i fit dey enjoy.
Kon help me to dey read your word time to time, kon make di bible my friend, and make me dey read am every time so i go fit enjoy on eart and i go fit enter your kingdom. Make your word open my hear, make your light shine fo my face so i go fit enjoy all di days wey i go live . Na in di name of Oga Jesus krist i ask all dis. AMEN
