Watch Yur Tongue, Mind Yur Words
He dey sinful make to dey offa special treatment for anyone. God want make hin shidren stop to dey separate daisef and he want make dem dey treat oda pipu di same way. Di skripture tok am say, “But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat. 9 If una do parsha, una dey kommit sin and di law don kondemn una as pipol wey nor dey do wetin dey di law.” (James 2:8-9).
LESSON
Pesin wey dey give special treatment na pesin wey dey unjust, and God no go free di pesin form hin jodgement. Shidren of God most to love pipu di same way kin treat dem di same way join. Nobodi dey allowed to det favour di rish pass di poor pipu. Nobodi most to dey respect pipu wey get pawa kon dey rubbish di komon pipu. Na Oga God kreate evribodi, and we dey equal for hin presence He dey send rain to evri land and evri pipu witout say he do any mago-mago. So, if Oga God dey kind and no dey do mago-mago, hin pikin too most to no dey do mago-mago. Anybodi – whether na Kristen or not – who dey do mago-mago go sofa plenti ponishment from Oga God.
PRAYER
Oga God, abeg help me to dey treat oda pipu witout mago-mago and di same way. No let me dey give special treatment to any pesin, but help me to dey treat evrione wit respect and love. Let me dey apply fear wey dey godly to wateva I do so dat I go fit receive yur blessin and nit kurse. Kon let me be channel of blessin to all pipu so dat yur name go dey praised evri time. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
