Try To Dey Spread Di Gospel Evri Time
Di bilivas’ konfident of hope most to be to live lives wey deklare di goodness of God. Di christian want most to dey similar to a psalmist wey talk say,
“My God wey get pawa, I go praiz You bikos of all di great tins wey You don do. I go tell evribody sey na only You dey do good. My God, na from wen I bi small pikin, You dey tish mi your ways and I always dey tell pipol about di wonderful tins wey You don do. Naw wey I don old well-well, make You nor leave mi. Make I tell dis new generashon And all doz wey dey porshu mi about your pawa.” (Psalm 71:16-18).
LESSON:
Di primary assignment wey Oga God give evri biliva na to preach di gospel of di Lord Oga Jesus Krist. Christians most spread di good news of God thru everi chance wey dem see. Dey most witness di gospel of Krist to di extent dat unbilivas go change dia mind kin bekom saved. Howeva, to preach di gospel na east task to perform. Evri christian most to share dia salvason experiens wit odas ( whether a family member or pesin wey be outsider) and enkourage dem to get from di same blessin.
PRAYER:
Oga God, I no fit thank you finish for all your goodness in my life. I ondastand say di fast way wey I fit show my appreciason to you na to preach gospel. Now, I ask say make you give me di grace to talk your good mews, so dat oda pipol go dey saved. Abeg fill my mouth wit your Holy Spirit kon use me as a living tools wey go fit bring fruits for your kindom. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
