To Dey Grow In Faith
Paul dey proud to commend the Thessalonians for dem effort wer dem get to serve di living God. He say,
“We dey bound to thank God always for una, brethren, as E dey fit, because your faith grow exceedingly, and di love wer every one of you abound toward each other, so that we ourselve go dey boast of you among the church of God for di patience and faith for all your persecutions and tribulations wer you endure” (2 Thess. 1:3-4).
LESSON:
Children of God dem expect to grow in di Lord. Di growth of our strength dey attach with how dedicate our service wer we offer to God. Also, we must dey consistent to study God’s word and pray to God so that we go fit get good soil to be water by God for our spiritual growth.
PRAYER:
Dear God, I wan make you dey proud of me as diligent Christian. Abeg help me so I go fit dey diligence by faith as I dey serve you, and by consistently studying bible. Also, help me so I go fit maintain stable relationship with you through prayer. For in the name of Jesus krist an him I make my requests. Amen.
