The Unique Birth Of Jesus
Jesus Krist kompletely dey unique. A virgin give birth to miracle pikin weh turn around to save di world. Di bible present, “Now how dem born Jesus Krist go like dis: After Hin mama Mary bin betrothed to Joseph, before dem come together, dem see an with Holy Spirit pikin. Den Joseph her husband, because e bi just man, and no wan make her public example, he dey minded to leave am secretly. But wen e dey he think about di things, behold, di Lord angel appear to am fo dream, sey, “Joseph, David son, make e no fear to take to you Mary your wife, because that pikin weh she carry fo her bele nah fo Holy Spirit. And she go born one boy, and you go call Hin name Jesus, because Hin go save Hin pipu from dea sins.” (Matthew 1:18-21).
LESSON
The story of how dem take born Jesus Krist dey kompletely different from any other human being. Hin mama Mary no get Hin bele fo relationship with any man. Nah Holy spirit visit am by di Holy Spirit to konceive Jesus. Di miracle pikin grow fo grace, strength, and pawa to fulfill Hin destiny - weh nah to save di world. Krist indeed occupy Hin position. He demonstrate significant strength; perform signs and wonders, and Hin proclaim God kingdom. Messiah open di pathway of salvation fo all pipu to become saved. He die fo sinner and resurrect to earn Hin followers with gift of eternal life. Hence, anyone weh konfess Jesus Krist as hin or her personal Lord and Savior go be saved. Meanwhile, salvation of Jesus Krist no apply to kristians only, anyone weh believe Am go be saved – irrespective of religion, race, or kulture.
PRAYER
Oga Jesus Krist, I believe sey you bi di Son of God weh come to save di world. Fo dis reason, I konfess you (Oga Jesus Krist) as my personal Lord and Savior; I give you my komplete life, and i go serve you with my life weh remain. I beg write my name fo di book of life, and keep me fit fo your second koming so that i fit be raptured with you to heaven. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
