The Most High Priest
Di high priests of Old Testament period offer animal sacrifice to clean human sins, but those sacrifice never perfect since di high priests themselves no dey perfect. To help stop human dilemma, God send Hin own Son as di perfect High Priest to sacrifice Hin life fo dea sins. Di Son of God no go slaughter animal fo sacrifice, but He go use Hin own life! Krist surrender Hin life fo all human, and Hin resurrect again as di bible attested,
“...Krist come as High Priest of di good things to come, with di greater and more perfect tabernacle dem no make am with hands, that one nobi, fo this kreation. Nobi with goat blood and calves, but with Hin own blood He enter di Most Holy Place once and fo all, having obtained eternal redemption. Because if bulls blood and goats and ashes of heifer, sprinkling unclean, sanctifies fo purifying of flesh, how much more di blood of Krist, who through di eternal Spirit offer Himself without spot to God, clean your konscience from dead works to serve di living God? And fo this reason Hin bi di Mediator of di new kovenant, by mean of death, fo di redemption of transgressions under di first kovenant, sey those weh dey call fit receive promise of eternal inheritance” (Hebrews 9:11-15).
LESSON:
Jesus Krist bi di Savior of di world, and Hin bi di Most High Priest with strong kapability to perfect redemptive work of human soul. He come to earth, die fo human sins, and resurrect to give life to pipu weh follow Am. Anyone weh konfess Jesus Krist as Hin or her Lord and Savior go automatically partake in Hin redemptive grace. Di bible analyze, “Sey Krist never enter di holy place make with hands, weh bi copies of true, but to heaven itself, now to appear in di presence of God fo us; nobi sey make He offer Himself often, as di high priest enters di Most Holy Place every year with blood of another—He then go have had to suffer often since foundation of di world; but now, once fo di end of di ages, He don appear to put away sin by di sacrifice of Himself. And as e dey appointed fo men to die once, but after this nah judgment, so Krist bin offered once to bear di sins of many. To those weh eagerly wait fo Am He go appear di second time, apart from sin, fo salvation” (Hebrews 9:24-28).
PRAYER:
Hallelujah krist sacrifice Hin life fo me so that i no go need any other sacrifice again. I beg God, I bi a partaker of Krist' grace. Henceforth, my name don dey written in di book of life, and crown of righteousness dey wait fo me fo heaven. Praise God, I dey saved and heaven nah my home! Amen.
