Stay wit God and dey enjoy hin benefit
Joshua wey be di servant of God talk wetin he see wit God afta he don live 110 years and he dey faithful among di Israelites. Joshua don see how God use hin miraku lead hin pipu out of Egypt kon bring dem to di promise land. The Israelites leader kon tell hin pipu to dey follow God's law so dem go dey receive hin benefits dey go. Joshua talk say;
“Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite fo Moses book wit kea, so dat una nor go fall go left or rite, or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dea god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem! But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.”
Fo una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today. Only one of una fit make 1,000 pipu run,bikos di Oga una God dey fight fo una as E promise.
LESSON
Oga God goodness no go stop on hin pipu wey dey serve him well-well, hin no go throway dose wey dey obey hin rule but he go bless dem. He no dey possibu make God throway hin pikin wey dey folow am, he go kuku stand by dem, kon show dem hin mercy. True-true, Jehovah go dey kea fo hin pikin, he go provide wetin dey want and dey he dey sure say dem go dey joli everitym.
But, dose wey no serve God and dose wey dey against him go sofa defeat from dea enemi. God no go sopot pesin wey dey do mago-mago since he no fit promote evil pesin wey dey do mago-mago wit God and he go dey open to di enemi attack and he no go get hin benefit. He good make pesin dey believe God, kon dey serve am well-well. pesin wey talk say hin love God must to talk di truth say oga Jesus krist na hin bi Lord and savior. Also, a mago-mago pesin(who don turn hin back to God) should repent and jejely return to hin God so he go get salvation, grace, safety, joy, peace and all oda benefit we dey ground fo God place. As God still dey alive, eni pesin wey trust and faithfully serve am go neva see shame but he go win all tins so hin go dey talk about hin goodness.
PRAYER
God abeg, i know say you love pipu wey dey kanpe wit you and you go reward dem fo dea good effort, i dey beg fo your grace so i go dey kanpe wit my service before you everitym. no allow me do mago-mago wit my faith but help me make i maintain my testimony fo say i bi true Kristen, abeg kon kip my feet stay kanpe fo your gate so i go fit receive your help on eart and also qualify fo your eternal benefits Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
