Servants Of God Must Be Faithful
Apostle Paul advise di Thessalonians kin say,
“Bikos wetin wi dey prish nor bi with mistake, dirty mind or wayo, but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef. As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money. Wi nor ever sey make pipol praiz us; weda na una or odas.” (1 Thess. 2:3-6).
Lesson:
Ministas of di gospel no be pesin wey go dey please pipol. Dey most deliva di gospel as di Holy Spirit tell dem, and dey most use di bible during dia preashing. Oga God go vex if any savants fails. Also, Savant of God most no porsu di success of dis eart kon forget di true gospel; dey most no dey selfish, and dey most kip dia faith during persekuson and sofa. Jehovah don kip hin full benefit for hin savants wey remain faithful to di end. He go bless hin savants kon decorate dem wit honor in heaven.
Prayer:
Oga God, abeg let me be a faithful savant before you. Help me to remain kanpe before you evritime. Give me pawa to dey preach your gospel witout mago-mago; kip me honest, and let ke remain fruitful for your kindom. Help me to remain strong during persekuson and let me kip my faith to the end. Abeg anoint me wit oil of gladness to kontinue dey share your gospel to all di world. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
