Repentance dey important to fit get Forgiveness
God don warn di Israelites to dey honor hin law and say make dem dey obey am, di pipu go api if dem obey, but dem go sofa if dem no obey hin laws, di enemies go get power over dem, throw dem fo bondage and go throway dem fo di world. Jehovah don provide a way which di Israelites go fit come back to am if dem later comot fo their sins, him go lead dem comot from di enemy hand and go bring dem back to dea promise land. God talk say "I don give una choice to choose between di blessing and di curse. Wen all dis tins don happen to una and una dey stay fo di nashons where di Oga una God skata una go, una go remember di choice wey i give una. If una and una shidren-shidren turn kom meet God kon obey all en kommand wey i dey give una today, with una heart and soul, den di Oga una God go sorry fo una. E go bring una kom back from di kountries wey E bin skata una, igo kon make una prosper again. Even if una skata for every where fo di eart, di Oga una God go gada and bring una kom back to una land. Di Oga una God go take una enter di land wey e give una grand-grand papa, so dat igo bi una own too, igo make una prosper and many pass una grand-grand papa dem". (Deut 30:1-6).
LESSON
God no like sin, but he dey like sinners wey don comot from dea sins. Jehovah no go throway any sinner wey don comot from his sins, wey don turn to am. He go show mercy and give di pesin joy wey dey his sons Oga Jesus krist hand.
I still dey tell u say God no fit receive pesin wey no comot for sin to his kingdom only if the pesin don comot for sin. Pesin must to comot for sin before God go show am love, pesin must to comot from sin before God go forgive am. Na only Oga Jesus krist wey bi di son of God wey die on di kross fit forgive pesin. Evri sinner go see forgiveness of hin sin because of Oga Jesus death and resurrection. Every sinner must come jejely to God fo forgiveness sake of Oga Jesus krist name. If person don do this, di person do get forgiveness,di person name go dey fo di book of life.
PRAYER
Oga God, i dey sorry fo every mago-mago weh i don do, i don comot for my sins and i dey ask fo forgiveness for di sake of di name of Oga Jesus krist. Abeg write your laws on top my mind, make me dey obey am well-well so u fit dey happy to jolly me Bless me with di holy spirit so i go start to live holy and life wey u go like so i go fit quality. Na fo Oga Jesus Christ name i ask all this. AMEN
