Our Guardian
Holy Spirit directed Philip say make he travel through a desert so he go meet and preach fo a man wey wan learn about Oga Jesus Krist. The bible tok say, “God angel kon tell Filip, “Get up make you waka fo di wildaness road wey dem dey pass from Jerusalem go Gaza.” So Filip kon dey waka dey go wea di angel tell am. As e dey go, e meet one uncle wey kom from Ethiopia, e bi offisa fo Kandace wey bi Ethiopia kween and na-im dey keep dea money. E kon woship God fo Jerusalem and e dey go house back. E sidan fo en horse dey read di book wey Profet Isaya write. Naim di Holy Spirit tell Filip, “Make you waka go meet di man.” (Acts 8:26-29). Philip hear wetin di Holy Spirit tok and he preach fo di traveler; di man kon give hin life to Oga Jesus Krist, and he baptized am immediately.
LESSON
Holy Spirit dey as a divine guidance of God to di belivas. Whoeva allow make di Holy Spirit operate fo hin life no go see failure but go get sound success wey go last fo life wey no dey finish. Di Spirit of God wok in many ways, and fit lead any kristen to carri out unusual task. Howeva, di Holy Spirit go only guide pesin wey please God, and he no go ever go against wetin di bible tok! Moreova, mirakus happun wen kristen respond to di leadership of di Holy Spirit: Pipu go receive salvation, healing, faith, assurance, and oda mirakus. Also, God go dey hapi weneva Hin shidren ansa to di leadership of his spirit. So, we fit tok say no regret dey fo pesin wey dey listen to di instructions and leadership of di Holy Spirit. Na Win Win situesan fo all parties. Devil na di only one wey go lose fo di process!
PRAYER
Oga God, abeg teach me how I go take reply to di leadership of di Holy Spirit. Make I dey prayerful and get sense, so I go fit ondastand evri instruction wey di Holy Spirit offas. Make me be savant wey get sense, wey dey listen to di voice of di Holy Spirit, and make me an obedient savant wey dey listen to instructions. No make me regret say I serve you, but help me to prospa fo dis life, and fo heaven also. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen
