Oga Jesus Na Di Only Way To Life Wey No Dey Finish
Paul shange from pesin wey dey distroy church to pesin wey de go church. He meet with Oga God kon change to christian. Paul tell him storry kon say, “I sofa Christians and I dey kill pipu wey dey serve God, dey tie pipu throw fo prison, weda dem bi man or woman and even di High Priest and di kansu eldas know about me. From dem, I collect letter go give dea brodas wey dey fo Damaskus, so dat I go arrest pipu wey believe Krist kon bring dem kom Jerusalem put fo prison. As I dey go, near Damaskus, around afternoon, one kind light from heaven kon shine round mi. Den I fall fo ground kon hear one voice wey say, ‘Saul, Saul, why you dey punish me?’ I answer, ‘Who you be Oga God?’ E kon say, ‘I bi Jesus Krist wey kom from Nazaret, wey you dey punish.’” (Acts 22:4-8).
LESSON
Oga God dey redi to see a sina repent from hin sin kon accept di salvation offa of Hin son Oga Jesus Krist. Krist salvation dey fo everybody. He dey precious but na free! Krist go accept any pesin wey kom to am. No mata how dirty di pesin life, Krist go clean am. He go repair our life wey don spoil kon give beta future to any pesin wey kom to am. All religions fit kom to Oga Jesus Krist. He go accept every pesin wey kom to am – whether na Muslim, Buddhist, Hindu, traditionalist, or oda. Na only through oga Jesus Krist we fit get life wey no dey finish salvason. Pipu wey dey do oda religion must to change dea kourse kon turn di followers of Oga Jesus Krist. All pipu must to confess Oga Jesus Krist as Lord to dey safe. Oga Jesus Krist talk am say, “Na Me be di road, di truth and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.” (John 14:6).
PRAYER
I don decide to dey follow Oga Jesus; I decide to dey follow Oga Jesus. I no go turn back; I no go turn back! I ( talk your name) declare Oga Jesus Krist as my Lord; I konfess my sin kon repent from dem. I give my complete life to Oga Jesus Krist, and I go serve you fo di rest of my life. I no go sin again! I no go play devil game again! My life na Oga Jesus Krist own from today, and forever more! Amen.
