Oga God Sees And Knows All
Act of wickedness na abominason to Oga God, and no wiked person go go unpunished. Di skripture talk about wiked pipol say, “Dem dey kill wimen wey dia husband don die, Strenjas and shidren wey nor get papa and mama again. Dem sey,
“God nor dey si us! Israel God nor even kare about wetin dey happen” (Psalm 94:6-7). Howeva, Oga God go repay evil pipol for dia wikedness. He dey written, “But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand? Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word? Abi di Pesin wey make una eye nor dey si? If E fit ponish wiked nashons, una tink sey E nor go ponish una? E know evritin, so make una nor tink sey E nor know wetin una dey do.” (Psalm 94:8-10).
LESSON:
Oga God sees and knows all tins; he go rewod wicked pipol wit ponishment wey heavy, onless dey repent. On di oda hand, di kreator go rewod pipol wey fear God on eart He go bless dem on eart kon kip di best place for dem for heaven. Now, all pipol most to dey fear God kon dey show goodness towards odas so dat dem go qualify for hin blessin.
PRAYER:
Oga God, abeg count me out of wiked pipol. I no wan dey wit evil pipol! Help me to dey love and fear you always. Help me to love oda pipol too. Abeg bless me today, tomorrow, and for di rest of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
