Oga God Fit Kontrol Our Problems
Jesus krist heal di man wey dey by di poll of Siloam even say di man no get di ability to fokus on di healer. Di man don fokus on hin problem too much to di extent say he no fit answer simple question wen Oga Jesus -di-healer come meet am. Di skripture talk say, “Wen Jesus see am liedan fo dea, e kon know sey di man neva fit waka fo long time. So, Jesus kon ask am, “You won waka?” Di man answer am, “Oga God, I nor get anybody wey go put mi inside di pool wen di wota dey shake. Anytime i dey try to enter di wota, anoda pesin go kwik enter before I reach dea.” Jesus tell am, “Make you get up! Karry your mart make you bigin waka.” At wons, di man stand up, karry en mart kon bigin waka. (Dat day na Sabat).” (John 5:6-9).
LESSON
No pesin must fokus on hin problem pass God. All pipu dey challenge to fokus on Oga God even say we fit dey face plenty challenge. Oga God na di solution to any problem wey face us. He get di pawa to solve any problem no mata how big di problem dey. No pesin fit solve hin problem by say he go just look am; howeva, di tin wey dey konfam be say problem go dey big if we fokus on am, but he go dey small if we fokus on Oga God. So, he dey good to dey fokus on God ova anything wey we dey face fo life!
PRAYER
Oga God, abeg bless me wit grace to dey fokus on you over all mata. No let me dey full with my wahala, but let me dey full with you make you give me grace to trust you say yes go solve all my problems, and you go give me viktory every time. Instead of pain and suffering, give me joy. Make you make my face shine well-well with your oil of gladness, and let me spend di rest of my life dey celebrate your benefit. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
