Love
The bible explain well well di essential requirement fo faithful kristian living. LOVE! E dey written,
“Now di purpose of di kommandment nah love from pure heart, from good konscience, and from sincere faith, from weh bi sey some, having strayed, don turn aside to idle talk” (1 Timothy 1:5-6).
LESSON:
Love nah key factor weh make kristianity relevant fo di world. Di whole thing about love start with God: He love di world and Hin send Hin Son Jesus Krist to save am from destruction (John 3:16). Krist come to dis earth fo di sake of love: He preach love and He die fo love! Fo dis reason, anyone weh get hope sey e dey go heaven must get love! However,we must not misinterpreted fo am to dey relevant. Love must be void of evil. Since God love fo humanity dey pure and perfect (agape), whatever we call love must dey undefiled also. Anyone weh claim seh get love must demonstrate am to glorify God. God pikin must get unconditional true and thorough love. Our love fo fellow humans suppose to be void of selfishness. Once we satisfy God with desire demonstration of love, He go shower Hin blessing ontop us beyond wetin anyone fit imagine!
PRAYER:
Dear God, I understand sey love na very important factor weh leads to godliness and holiness. No one fit inherit your kingdom without true love. Fo dis reason, I humbly seek your Spirit of true love. I beg give me your Holy Spirit to truly love you and love other pipu around me! Let my love fo you dey unconditional, and make me serve you with all my heart. Empawa me to love my friends and neighbors, and sincerely seek dea peace and prosperity. I beg, keep my heart pure, so that I gol live an acceptable life to di fit to inherit your kingdom. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
