KOFIDENCE IN GOD
God tell isrelite make dem demonstrate courage and make dem nor fear dea enemies wen di fight dey go. He kompulsory ham for dem sey make dem nor fear dea enemies even if dem plenty pass dem.
God tell him pikin dem sey make dem remember di gud tin wey him don do fo dem before wey don pass,he com sey make them take ham build konfidence for di victory go com.
That same God wey kari dem komot fo egypti and give dem success make dem pass widaness go still dey dea side to help dem win all di fight wey remain. (Deut 20:1) Wen una go fight una enemies and una si dea horse and dea soja wey strong pass una own,make una nor fear.
Di oga una God wey bring una kom out from Egypti dey wit una.
LESSON
God pikin nid to dey get konfidence in God well,even if di situation serious nor matter how di kind battle dem face. If na physical or na spiritual, God get power to win ham. Di person wey make us go fight fo him pikin eni how ibi. Him go give us victory. Anybody wey believe ham must not forget sey dat God wey dey kontrol di world dey our side. Him big reach make him power pass anything wey our enemies get. Him go overide di enemies original skill go also overide dea weapon make him name fit bi glorify fo our life.
PRAYER
Dear God, i no sey you bi God of miracle and you go fo sure perform your miracle make he favor mi. Na why i dey ask sey make you stand fo me,make you show yourself strong and make you bring glory to your name. Abeg no give my enemies chance to talk and make you overide di evil wey dem get fo my life. Make you help me fight my battle, make you give me victory.
Make i get testimony to give glory to your holy name. In Jesus name i pray fo wetin i want Amen.
