Holiness dey ogbonge to dey work wit God
One Israelites wey dem dey kol Achan tel him famili make dem sin to God and wetin dem do kon cause make hin famili fall finish. God no talk to di Israelites, dey kon sofa well-well from dea enemi wey no get power reach dem.
But, God show am to Joshua di tin wey odas no see, kon say “Make you get up! Wetin make you face ground dey mourn? Israel pipu don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey i say make dem keep fo mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dea own property. Israel pipu nor fit stand for dea enemies front; dem run because disgrace don dey follow dem. I nor go dey wit una again, unless una destroy wetin make dis wahala dey happen to una. (Joshua 7:10-12).
LESSON
God talk am fo holiness well-well and all hin pikin must to dey holy before dem go enjoy hin beta sekuriti. No shaid of Oga God must to dey live fo sin kon dey call God grace make hin come to am. wetin God talk dey simple and na di same.
He go follow pesin talk hin sin, kon leave am, but he go dey far from pesin wey still dey fo sin make Kristen no go do God wayo wit holiness wey no be konfam one. we no fit lie fo di kreato and hin go still dey talk am fo di holiness. So, oga God fit still no tank us even wen we dress well-well or bring beta offerin come church until we don do wetin he talk fo holiness. God go only collect our offerin wen we don live sin, kon dey live fo holiness.
PRAYER
God abeg, kon help me make i dey fo holiness, make i dey kanpe wit you evritime. Kon guide me so i no go fall fo sin, make devil no go use dat one enta me. make i dey quick live my sin, kon dey quick get your forgiveness. Abeg kon give me a heart wey go dey follow your rules so i go dey joli fo di days of my life so dem go accept me fo your kindom. Na fo oga Jesus name i beg all dis. AMEN.
