God Will Not Cast Down Forever
Israelites weh survive war-time go also enjoy peace di Lord peace. God promise to reinstate Hin lost pikin to dea heritage - with guaranteed rest and dey safe. E dey written inside bible,
“At di same time,” di Lord talk am, “I go be di God of all di family of Israel, and dem go be my pipu.” The Lord talk am: “Di pipu weh survive di sword Found grace fo di wilderness— Israel, wen i go give am rest” Di Lord don appear to me like E dey do in old time, say: “Yes, I don love you with everlasting love; Fo dis reason with loving kindness I don drawn you” (Jeremiah 31:1-3).
LESSON:
God nah everlasting Lord weh get love and mercy, and He go forever show mercy on Hin own pikin dem. He no go cast away Hin pikin forever, but He go show dem mercy. Jehovah go restore Hin pikin from dea pitfalls, He save dem wen crisis come. However, di kompassionate God still expects hin pikin to exercise repentance; He want make we get renew mind and change of behavior prior to our restoration. E dey important sey make God pikin submit to God with humble heart, and genuinely repent from hin or her sin. Any individual weh humbly come before God go be redeemed. E dey written "Come to Me, all you weh labor and are heavy laden, and I go give you rest" (Matthew 11:28).
God go stretch Hin forgiving arms towards any person or group of pipu weh dey humble enough to repent from dea sins. He go erase dea sins and reverse Hin punishments on dem. Jehovah go care fo repentant sinners, and give dem peaceful habitations.
PRAYER:
Dear God, I dey sorry fo all my sins! Today, i repent from all my wrong doings, and i return to you in good faith. I beg wipe away my sins and redeem my soul. Give me godly heart to karefully obey your instructions and serve you faithfully. From now on, I yield my komplete life to you, and i go faithfully serve you fo di rest of my life. I beg restore di joy of your salvation back to me. Write my name fo di book of life, and forever keep me fit to inherit your kingdom. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
