God Wants Us Make We Repent
Di Pharisees understand sey Oga Jesus Krist na moral tisa and dem dey smell am say na Him be di Messiah wey dem dey expect but dem decide say dem go deny am. So, di Pharisees set traps so Oga Jesus go fall. Dem test am with many questions wey dey hear, with di hope say he fit fall fo wetin he go talk. One example of wetin di Pharisees plan be say, “Di pipu wey sabi di law and di Farisee pipu kon bring one woman wey dem catch sey e sleep with man wey nor bi en husband. Dem kon make am stand fo dea front, den dem tell Jesus, “Tisha, we katch dis woman wen e dey sleep with one man wey nor bi en husband. Moses Law sey, ‘Make dem stone dis kind woman till she die.’ Wetin you get to talk fo dis matter?” (Dem ask am dis kweshon to set trap fo am, make dem fo fit katch am). But Jesus bend down kon take en finger dey write something fo ground. Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.” E kon bend down again bigin rite fo ground. Wen dem hear wetin e talk, dem kon dey komot fo dea one-by-one. Na di old pipu first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand fo en front. Den Jesus stand up ask am, “Madam, where di pipu wey bring you? Nobody remain to kondemn you?” (John 8:3-10)
LESSON
God no get interest to pursue anybody or send dem to hell. Di kreator dey interested to repentans of sinas. He want make all pipu repent from dea sins, kon accept hin Son Oga Jesus Krist as dea personal Lord and Savior. Anybody wey believe in Oga Jesus Krist go escape di punishment of hell, but sina wey no repent go dey rejected fo heaven and go dey cast fo hell fire. (Since Oga Jesus get pity, he no go reject anybody wey keep dea trust fo am). Di step of salvation dey easy and na free. However, salvation requires say make pesin konfes hin faith in Oga Jesus Krist.
PRAYER
Oga Jesus Krist, I konfes say you be di son of God wey die fo di sins of di world. You don die kon wake up to give me life wey no dey finish, now I konfes you say you be my Lord and personal Savior. I offa you all my life, and I go serve you fo all di days of my life. Abeg write my name in di book of life, and make me qualify to enjoy with you fo heaven. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
