God Loves The Humble
Youths dey enkoraged to use dea knowledge wey still fresh and energy to serve Oga God an any opportunity wey a youth get to serve God today no fit dey tomorrow. Di skripture tok am say, “So, make you remember and honor di Pesin wey kreate you naw wen you still dey yong, bikos wen you don old, you go sey, “Life nor sweet again.” (Ecclesiastes 12:1).
LESSON
God want make youths to dey serve him wit everi opportunity dey get. Some opportunities dey time-sensitive: A youth wey get strength to serve God today may fit no get strength few years leta. Di fresh education, knowledge, and technological thinking wey a youth get today fit no dey useful tomorrow. So, youths must to konsida to dey serve God now – wen dey get di best opportunity to do so! Howeva any youth wey fail Oga God at hin flower age fit miss God original porpos fo hin life. A young pesin wey fail to know di porpos of Oga God fo hin life go regret in future. So, na “Win Win”who situesan fo any youth to dey serve God faithfully. Di effot go make God hapi, and go change to personal blessin and testimoni.
PRAYER
Oga God, please let me dey live all my life for you. Help me to dey give di early stage of my life into your faithful services. Help me so I go use my time, energy, knowledge, finances, and oda resources fo your services. Let me komit my life and my services to you patapata, so dat pipu go plenti fo your kindom. Abeg let my services dey acceptable before you, and let me dey receive your blessin wey plenti fo di days of my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
