God Get Di Sekret Of Success
Kontinuos prayers help di early church to dey strong and dey successful. Even sey persekutions from outside and division from inside, Kontinuos prayer help di early kristens to kontinue to prospa and move to oda regions of di world. Holy Spirit tell di saints kon teach dem wetin dem go do next. Fo example, di Holy Spirit guided di saints make dem pursue Saul (Paul) and Barnabas outside dea border to preach gospel. Dem obey; Paul start a crusade outside di land of Israel, and everibodi on earth kontinue to dey feel di impact till today. We fit trace di wondaful As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul fo di work wey I wont make dem do.” Afta dem don fast and pray finish, dem pray fo Banabas and Saul kon send dem go. testimoni to Acts 13:2-3.
LESSON
Any pesin or a group of pipu wey pray kon put obediens to anitin wey God say first go prospa – fo sure. God get di sekret of success, and he dey show am to Hin shidren through dea obediens No one fit imagine his greatness; di pesin go dey soprise to see how much God go bless am through obediens. Also, a Kristen wey dey pray kon dey listen to anitin wey God talk go win on eart. No shalenge go fit stop di original plan wey God get fo his life.
PRAYER
Oga God, abeg help me dey find your face in prayers and dey honor anitin wey you say so I go fit prospa. Kon help me to dey trust you say you dey in charge of my life, and notin fit spoil your original plans wey you get fo me. Let me dey jejely obey you so dat I go succeed and get testimoni wey go dey with me Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
