Eni pesin wey honor God, God go surely reward am back
Joshua who say na hin lead di Israelites kolet di promise land sef collet hin own part wey dey land wey dem kolet, Israelites give am to Joshua wetin hin sopos collet becos of wetin God use am do for dem. Joshua stand gidigba all di tym wey hin don dey lead di Israelites and even before he bi di Israelites leader. Wen he be spy, Joshua join caleb for di wilderness to konfam God promise and talk say dem go kolet di promise land (oda spies talk am say dem no fit kolet am). Di scripture talk am how Joshua get hin reward becos he dey faithful;
Wen dem don divide di land into seven, Israel pipu kon give Joshua, Nun pikin some land. As God talk, dem kon give Joshua di town wey e ask fo, wey bi, Timnat-Serah fo Efraim hill kountry. So Joshua build di town kon bigin stay dea,Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders, na dis bi di whole land wey dem divide and dem rite am fo book kon put am fo Shiloh fo God present. So, dem kon divide di land finish.
LESSON
God go honor and bless pipu wey fit do anitin fo di glori of hin name, hin go bless dem fo evritin wey dem do. Belivas must always stand up fo God work and dey defend am anyhow dey fit do. kristens no sopos dey do anyhow wit God work. Also, we no sopos dey do anitin wey God talk say make we no do. Belivas most to dey stand up fo God and preach hin gospel as hin give am to us. we most to dey do like oga God himsef so oda pipu go dey learn from us and dis go make pipul come close to God. oga God knows how he go reward di pikin wey dey listen to am and he go reward evri good tin wey he do to am. oga God don show to us say hin dey faithful akordin to wetin dey down, he don reward pipu for di bible and he go still do di same fo our time. Di same God wey honor Joshua and Caleb fo di good tin wey dem do go reward evri beliva wey stand up to defend hin interest fo dis life.
PRAYER
God abeg, kon help me make i dey live a beta life before you so i go fit kolet di benefit wey dey behind am. Help me make i dey stand up fo righteousness and dey defend wetin you want always even wen he no dey okay fo me! make my life dey kanpe wit wetin dey fo di bible so i go fit honor your name. i know say yu go reward pipu who serve you well-well, na him make me kon dey beg you say make you reward me! Kon bless me pass wetin i dey think, make my testimony of your goodness dey forever. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
